Day of di African Child: Pregnant girls, young mothers no dey go school – Human Rights Watch
Day of di African Child: Pregnant girls, young mothers no dey go school – Human Rights Watch
International NGO Human Rights Watch tok say plenty pregnant girls and young mothers no dey go school across Africa because dem no dey let dem
Dem tok dis one as dem join pipo around di world to celebrate African Union Day of di African Child.
Di 2019 theme dey focus on children’s rights and action for Africa For di report wey dem release to chook eye for di mata, dem say even though say some Africa gofments say dem go ensure say pregnant girls go school, kontris like Equatorial Guinea, Sierra Leone, and Tanzania dey ban dem from gofment schools FGM: Wetin e be, wia & why e dey happun “Na men dey look down on girls like say we be second-class citizens Di organisation tok say Africa get di highest pregnancy rates for di world according to di United Nations and di tin dey happun for child marriage, something wey African gofments never fit address wella Oda reasons dem give na abuse, lack of sex education and no access to family planning.